Trump hint on end to Iran war as Putin, China react to Mojtaba appointment as supreme leader of Iran

United States President Donald Trump don dey tok different-different tins bout di war wit Iran as di kasala don reach Day 10.

For comment to different tori pipo ova phone calls, Trump tell tori pesin from di New York Post say, “I get plan for evritin, you go dey very happy”, e tell CBS News say di war “dey very complete, pretty much”.

E add say, “we dey very far ahead of schedule” but wen dem ask am weda e go soon end di operatio bicos of dat, Trump say, “I no know, e depends. Wrapping up dey inside my mind, nobody else.”

Just some days ago, Trump bin tok say im no go stop do war till Iran “unconditional surrender”.

Credit: BBC

blank
blank

Related Articles

Back to top button